President-elect Donald Trump say e go chook eye for pardon for those wey involve for di 2021 US Capitol riot on im first day back in office next month.
“Dis pipo dey live in hell,” e tell NBC Meet the Press for im first broadcast network interview since e win di November election.
Di Republican also vow to end automatic citizenship for anybody dem born for di country, but e offer to work with Democrats to help some undocumented immigrants wey dem bring come US as children.
For di interview wey dem record on Friday, Trump promise to issue “a lot” of executive orders, including on immigration, energy and di economy, after dem inaugurate am on 20 January.
While e suggest say e no go seek justice department investigation into Joe Biden, e say some of im political adversaries, including lawmakers wey investigate di Capitol riot, suppose go jail.
Dem ask Trump whether e go look to pardon di hundreds of people convicted for dia involvement in dat riot, wen im supporters storm Congress three months after im defeat for di 2020 election.
“We go look independent cases,” e tok. “Yeah, but I go act very quickly.”
“First day,” e add.
Trump continue: “You know, by di way, dem don dey dia for years, and dem dey dirty, disgusting place wey no supposed dey allowed to dey open.”
Di president-elect make other news for di NBC interview wey dem show on Sunday:
- E offer a caveat on whether e go keep di US for di North Atlantic Treaty Organization (Nato): “If dem dey pay dia bills, and if I think say dem dey do ok – dem dey treat us fairly, di answer na absolutely, I go stay with Nato”
- Trump say e no go seek to impose restrictions on abortion pills, though wen dem ask am to make a guarantee, e add: “Well, I commit. I mean…things dey change”
- Di Republican say make Ukraine “probably” expect less aid wen e return to di White House
- Trump say e tink say “somebody need to find out” if link dey between autism and childhood vaccines – idea wey multiple studies don rule out around di world. Trump suggest say im nominee for health secretary, pesin wey no too send vaccine, Robert F Kennedy Jr, go look into di matter
- Di president-elect repeat im promise say e no go look to cut Social Security, or raise im eligibility age, though e say e go make am “more efficient”, without adding further details
- Pressed on whether im plan to impose tariffs on imports from major US trading partners go raise consumer prices for Americans, e say: “I no fit guarantee anything. I no fit guarantee tomorrow”.
On birthright citizenship for US
On di subject of immigration, Trump tell NBC say e go through executive action look to end di so-called birthright citizenship, wey dey entitle anybody dem born for US to American passport, even if dem born dia parents elsewhere.
Birthright citizenship come from di 14th Amendment of di US Constitution, wey say “all persons born” in di United States “be citizens of di United States”.
“We go have to change am,” Trump tok. “We go maybe get to go back to di people. But we have to end am.”
Trump also say e go follow through on im campaign pledge to deport undocumented immigrants, including those with family members wey be US citizens.
“I no wan break up families,” e tok, “so di only way you no go break up di family na say you go keep dem together and you have to send dem all back.”
Trump also say e wan work with Congress to help so-called Dreamers, undocumented immigrants wey bin dey covered under di Obama-era programme, Deferred Action for Childhood Arrivals, wey Trump once try to scrap.
“I go work with di Democrats on a plan,” e tok, adding say some of dis immigrants don find good jobs and start businesses.
Trump be like say e offer mixed signals on whether e go follow through on im repeated vows to retaliate against political adversaries.
Outgoing US President Joe Biden dis week issue a sweeping pardon to im criminally convicted son, Hunter. Di Democrat dey reported to be considering oda blanket pardons for political allies before e leave office next month.
Trump seemed to indicate say e no go seek a special counsel investigation into Biden and im family, as e once promised.
“I am not looking to go back into di past,” e tok. “I dey look to make our country successful. Retaliation go dey through success.”
But e also say members of di now-defunct, Democratic-led House of Representatives committee wey investigate am “suppose go to jail”.
One member of di panel, former Republican congresswoman Liz Cheney, hit back at Trump on Sunday.
She say im comment say members of di committee supposed dey jailed na a “continuation of im attack on di rule of law and di foundations of our republic”.
For im NBC interview Trump also say e no go direct FBI to pursue investigations against im enemies.
But e also tell di network: “If dem dey crooked, if dem do something wrong, if dem break di law, probably.
“Dem go after me. You know, dem go after me, and I no do anything wrong.”
+ There are no comments
Add yours